Friday, August 28, 2015

A Poem I'm Beginning to Love

I told you I would be posting regularly! I'm a writer now, I have to at least act like its legit.

One Wife for One Woman- Frank Aig-Imoukhuede
I dey try go church, I done go for court
Dem all day talk about di ‘new culture’ ;
Dem talk about ‘equality’ ,them mention ‘divorce’
Dem holler am so-tay my ear nearly cut;
One wife be for one man.
My fader before my fader got him wife borku
Eno’ get equality mapalaver, he live well
For he be oga for im own house
But dat time done pass before white man come
wit’im
One wife for one man
Tell me how una woman no go make yanga
Wen’e know say na’im only day.
Supose say-make God no ‘gree-‘e no born at all?
A ‘tell you dat man bin dey crazy wey start
One wife for one man
Jus’ tell me how one wife fit do one man;
How you go fit stay all time for him house
For time when belleh done kommot.
For how many pickin’ ,self, one woman fit born
wen one wife be for one man?
Suppose, self, say na so-so woman your wife dey born
Suppose, your wife sabe book, no’sabe make chop;
Den, how go tell man make’e no’ go out
Sake of dis divorce? Bo, dis culture na wayao!
wen one wife be for one man.

No comments:

Post a Comment

Ad 1